I LOVE MY COUNTRY Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by
loading
#200 MTN Recharge Card, Very soon Etisalat go say recharge #200
and win a
big ship. =D Then Airtel go com follow sey, recharge #100 an win
benin republic. =D Glo, go jus kuku say... Recharge 500 and win
Nigeria
bcos there colour na Green =D Na only for Nigeria you go see fish
inside "MEATPIE"
=D Na only for nigeria we dey count money after we
withdraw am from ATM because we no even trust
ATM machines.=D Na only for Nigeria PHCN dey sey:
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill
(wat a pitY)=D Na only fo Naija people dey horn for traffic light make
e quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy
dey sell Coke, Recharge
Card, Chin chin, Puff puff, Ogogoro and beer.=D Wetin you u no see
for Naija, you no fit see am
anywhere in d world... Trust me. Abeg na joke o, make anybody
no take am personal O =)) I love Naija die!....